President Muhammadu Buhari don tell all im cabinet members wey wan contest di 2023 elections to resign.
Di Nigerian leader give federal ministers until May 16, 2023, to quit and face dia political ambition.
Information Minister, Lai Mohammed, confam di tori Wednesday afternoon for State House, Abuja.
Buhari give di directive during di Federal Executive Council meeting wey im lead.
Di only pesin wey di marching order no affect na di Vice President, Yemi Osinbajo wey also declare interest to contest presidential election.
Nigeria electoral law require appointed goment officials to leave dia offices before participating in an election as candidates.
E no dey yet clear wen di president go appoint di ministers wey go replace those affected.
Plenti of Buhari cabinet ministers don already declare intentions to be dia party candidates.
Dem be aspirants for either presidential or state govnorship elections wey dey hold next year.
Chibuike Rotimi Amaechi – Minister of Transportation
Godswill Akpabio – Minister of Niger Delta Affairs
Ogbonnaya Onu – Minister of Labour and Employment
Chris Ngige – Minister of Science and Technology
Emeka Nwajiuba – Minister of State for Education
Timipre Sylva – Minister of State, Petroleum Resources
Uche Ogar – Minister of State, Mines and Steel Development
Abubakar Malami – Minister of Justice and Attorney-General
Paulline Tallen – Minister of Women Affairs
Wia dis foto come from, State House
Minister of State for Education, Emeka Nwajuiba resign on Wenesday from im post to pursue im presidential ambition, reports tok.
Di move fit get an impact on di running of goment activities as e be say high number of ministers dey affected by di decision.
However, President Buhari tok-tok pesin tell BBC say goment activities no go dey affected.
All political parties dey expected to conduct dia primaries later dis month.
Na for February President Muhammadu Buhari sign di electoral act 2022 into law.
Section 84(12) na part of di Nigeria Electoral Act 2022.
One of di clause wey dem newly introduce for di new electoral act na section 84(12) wey provide dat anyone wey hold political office – ministers commissioners, special advisers and odas – must give up di position before dem go fit dey qualify to participate for di electoral process either as candidate or as delegate.
Section 84(12) of di electoral act 2022 provide say: "No political appointee at any level go be voting delegate or be voted for during di convention or congress of any political party for di purpose of di nomination of candidates for any election".
Wetin dis mean be say, any pesin wey dey hold political appointment like ministers, commissioners, special advisers, personal assistants dem, weda dem dey serve for federal or state level no go fit vote and nobody go fit vote for am for primaries.
Therefore, since nobody vote for am for primaries, e mean say im no be candidate for any election.
Di only way pesin fit be candidate na to resign before di primaries.
© 2022 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.
